Warning: file_put_contents(/opt/frankenphp/design.onmedianet.com/storage/proxy/cache/12c5f0d079e5a03da0519086056f92ca.html): Failed to open stream: No space left on device in /opt/frankenphp/design.onmedianet.com/app/src/Arsae/CacheManager.php on line 36

Warning: http_response_code(): Cannot set response code - headers already sent (output started at /opt/frankenphp/design.onmedianet.com/app/src/Arsae/CacheManager.php:36) in /opt/frankenphp/design.onmedianet.com/app/src/Models/Response.php on line 17

Warning: Cannot modify header information - headers already sent by (output started at /opt/frankenphp/design.onmedianet.com/app/src/Arsae/CacheManager.php:36) in /opt/frankenphp/design.onmedianet.com/app/src/Models/Response.php on line 20
Wikipedia Jump to content

Main Pej

From Wikipedia

Welkom to Naijá Wikipedia

October 3, 2025 Na 1,503 pej-dem dey for Nigerian pidgin

Atikul for dis wik

Mejai Bola Mike Avoseh na profeso for one yunivasti wey dem dey kol University of Dakota. Di tins wey im dey tich na abaut skul wey pipul wey no bi smol pikin dey go, how difren pipul dey du dia difren difren kolsho for di wold an abaut som patikula ples-dem. Avoseh folo for di join-bodi for di grup wey dem kol American Association for Adult and Continuing Education (AAACE) sins 2016 an e stil folo dey for International Society for Comparative Adult (ISCAE) from 2020 go rich 2023 an na im bi di oga kpata-kpata for di Commission for International Adult Education (CIAE) for inside AAACE...Read-am dey go...

You sabi am?

* Alvan Azinna Ikoku (August 1, 1900 – November 18, 1971) na Naija pesin wey bi politishan, pesin wey dey stand gidigba for pipul an pesin wey dey sopot edukeshon mata...Read-am dey go...

* Abba Musa Rimi, CON (dem bon am for 28 February 1940) na one man from Naija wey pipul chuz-am mek e bi di pesin wey go rul dem for Kaduna Stet for 1979 wen Naija dey for dia Sekond Ripoblik, dis wan kon mek am bi di pesin wey go dey du like govno for dat time wey dem komot Govno Abdulkadir Balarabe Musa as di govno for 23 June 1981...Read-am dey go...

Atikul for todey

Gun langwej (Gun: gungbe) na langwej wey Ogu pipul wey dey for Benin Replublic an Naija dey tok. Gun langwej dey among di langwej grup wey dem dey kol Gbe. Di langwej near oda langwej like Fon, Agbome, Kpase, Maxi and Weme (Ouémé). Na dis langwej dem dey tok pas for Benin an dem dey yuz am tich for some skul-dem for Ouémé Department for Benin...Read-am dey go...

Pisho for todey

NIG-ARG_(2)
Naija futbol team